Lyrks
Lyrks
Sign In
Cover Art

Illusion Lyrics by Brymo

2022

You carry Boyi go yonder
You say he no go go oh
Slavers boku round town him brother tell am oh
Stand for your ground
Make you no hurry follow go
Them dey sell people troway
My brother no go oh

The people them wey go river them never return oh
Them say na mami water carry everybody go oh
For full moon, papa go farm he never return oh
Them say na the forest carry am swallow oh

Listen Boyi
Life no balance at all oh
You go place you no know
You no go return oh

Boyi feeling true
Him heart dey beat for the road oh
Him fate na to follow them
Follow journey go


Ah ah ah ah ah
Wetin I think I become ah
Ah ah ah ah ah
Na illusion them dey sell you so


Boyi look forth, him look out, no other place to go oh
He carry him few belongings, reluctantly follow go

For this life we dey, the things you do you know oh
E better to go reach the place find how e dey oh

I talk am, I shout am, Boyi still dey travel go
Na destiny dey push man where him dey go ah

He try am, he fight am, urge strong no be small
The tori e dey the place where him dey go ah

Ah ah ah ah ah ah
Na wetin I think I become
Ah ah ah ah ah
Na illusion dem dey promise you so ah

Hmmn hmmmn hmmn
Oga master no wan know value pig fat pass people oh
He say dem be property with him dog dem equal oh

Boyi clean gun, he shave beard
Oga trust no other
He for adopt Boyi, but him people go hala

That night Boyi take razor he shave am proper The way Oga dey like am
No touch him moustache ah

Poison for soup
For family and the guys them
He slash master throat too from ear to ear ah

Ah ah ah ah ah
Boyi na most wanted for strange country ah
Ah ah ah ah ah
He dey gather soldiers ah
From plantations he dey break boys free ah

(Clears throat)
Ehn ehn
My people
The main reason we gather here today, na him concern us now
Na there we dey go next
Ah today on behalf of the people of the city and the township, the entire tribe and our very very race, we go unveil this statue of boyi
We go give our honorable personality himself the scissors to use cut the ribbon
For service to humanity and to race and eh we salute you sir
We salute you well well, because you really touch our lives, you don change our lives from generation to generation to come
Nothing go ever remain the same for us
Yes, this statue na the honor of your greatness
Thank you
Credits

About “Illusion” by Brymo

Read the complete lyrics to "Illusion" by Brymo in 2022. On Lyrks you can follow along with the full text, explore the artist's discography, and discover related songs. The track is often categorized under Pop.

"Illusion" is performed by Brymo. in 2022 This page provides the full lyric text for fans who want to sing along, study the songwriting, or compare versions across releases. Lyrks organizes lyrics by artist and song slug so you can bookmark and share a stable URL. Music lyrics help listeners connect with emotion, narrative, and rhythm in a track. Whether you are learning English, researching a favorite chorus, or preparing for karaoke, having accurate line breaks and section labels (verse, chorus, bridge) makes the experience easier. We link to the official artist profile on Lyrks where available, including biography snippets, top songs, and chart placements when we have that data. If you enjoy "Illusion", explore more songs by Brymo using the links below. Chart and trending pages on Lyrks highlight what listeners are searching for this week. For copyright or correction requests, see our DMCA and contact pages.

View all songs and biography for Brymo · Trending lyrics · Billboard Hot 100

Frequently asked questions

"Illusion" is credited to Brymo. Songwriting credits may include additional writers listed on the release; check the credits section on this page for linked collaborators.

Album information for "Illusion" is not available in our database yet. You can still read the full lyrics on this page.

Visit the Brymo artist page at /artist/brymo for biography, popular tracks, and links to more lyric pages.


Lyrks
Lyrks

Your gateway to the world of music lyrics.

Product

Features


© 2026 Lyrks. All rights reserved.